
How to understand stock indicators
You don ever wish say you get cheat code for trading? RSI (Relative Strength Index) and SMAs (Simple Moving Averages) fit be di next best thing! Dis popular technical indicators fit help you know wen to enta trade technical indicators and wen to exit. Make we break am down.
Wetin be RSI?
RSI dey help show weda dem don buy stock too much (overbought) or sell am too much (oversold), and dis fit suggest say di price fit change direction soon. E dey work on a scale from 0 to 100:
- Above 70? Di stock fit be overbought and im price fit soon fall back.
- Below 30? Di stock fit be undervalued and im price fit rise again.
- Default setting: 14-day RSI, but you fit adjust am to suit your strategy.
Wetin about SMAs?
SMAs dey smooth out price action, so you fit see di bigger trend. Di two SMAs wey pipo dey use pass na:
- 50-day SMA: Indicator for short-term trend
- 200-day SMA: Indicator for long-term trend
How SMA crossover dey work
You don ever hear about golden cross and death cross? Dem dey happen wen:
- Golden cross: Di 50-day SMA move above di 200-day SMA → Bullish signal
- Death cross: Di 50-day SMA move below di 200-day SMA → Bearish signal
Why you go use RSI and SMA together?
RSI and SMA dey work well together to help you spot trends and reversals. Each one dey useful on im own, but wen you use dem together, dem dey give you much clearer picture.
- RSI dey show you if stock price too high or if na good price to buy am.
- SMA crossovers dey show you di direction wey di trend dey go.
For example, if di RSI dey below 30 (oversold) and di 50-day SMA cross above di 200-day SMA, na strong buy signal be dat!

Wen RSI and SMA strategies dey work well
Earnings season
Company earnings reports fit cause big price swings. RSI and SMAs dey help you filter out di noise:
- RSI dey show if stock dey overbought or oversold afta price move because of earnings.
- SMA crossovers dey confirm if di move na part of bigger trend or na just short-term hype.
Market corrections
Wen di Market fall sharply, RSI fit help you identify oversold stocks, while SMAs dey confirm if na time to buy or if di downtrend go continue.
How to set up your RSI and SMA trade
Bullish setup (opportunity to buy)
- RSI dey near 30 (oversold)
- Di 50-day SMA cross above di 200-day SMA (golden cross)
Bearish setup (opportunity to sell)
- RSI dey near 70 (overbought)
- Di 50-day SMA cross below di 200-day SMA (death cross)
Example of RSI and SMA crossover: Amazon (AMZN)
Wen you look Amazon stock chart, suppose say:
- Di 50-day SMA cross above di 200-day SMA → Confirmation of uptrend
- RSI dey near 30 → Price fit change direction from oversold levels
Dis signals together suggest say opportunity dey to buy.
How to manage risk for RSI and SMA trading
Where to place Stop Loss
- Earnings volatility? Use wider Stop Loss (2–3% below entry).
- Normal conditions? Keep am closer (1–1.5% below entry).
- Consider di stock Average True Range (ATR) to help you choose better Stop Loss levels.
Profit targets
- Short-term trades: Take profit wen RSI dey near 70 or di SMA crossover dey weaken.
- Long-term trades: Hold as long as di 50-day SMA dey above di 200-day SMA, and sell gradually wen RSI reach extreme levels.
Important trading tips
Before you enta trade, consider:
- Multiple timeframes (daily charts for trends, hourly charts for precise entries)
- Market conditions (overall Market direction, sector trends, news about di particular stock)
- Earnings dates (so you fit avoid surprises)
- Stock liquidity (higher volume = smoother trades)
Start to test RSI and SMA strategies today trading strategies
Dis indicators dey powerful, but dem dey work best as part of broader strategy. Practise RSI and SMA strategies wit free Deriv demo account. Na great way to improve your skills before you trade wit real money.
Quiz
Wetin dey confirm bullish trend?


