
Forex fit sound like something wey hard to understand, but e actually dey easier to access than you fit think. Imagine say you dey one busy international market, no be spices and souvenirs you dey see, but currencies from all ova di world!
Wetin be forex?
Forex na short form for “foreign exchange”, and e simply mean di process of buying and selling different currencies. Na di biggest and most active financial market for di world, wia pipo dey trade trillions of dollars evri day.
Why forex market dey?
Imagine say you be American company wey wan buy products from Chinese manufacturer. You need to pay dem wit Chinese Yuan, but na only US Dollars you get. Na wia forex market come in be dat. Na global network of banks, brokers and institutions wey dey help convert one currency to anoda.
Dis exchange dey happen all di time, all ova di world, and e dey help global trade and investment run smoothly.
How forex trading dey work?
Because of modern technology, everybody fit now access forex trading through online platforms like Deriv. Na dis be di basic idea:
- Currencies dey come as pairs: You dey always trade one currency against anoda, like di Euro against di US Dollar (EUR/USD) or di British Pound against di Japanese Yen (GBP/JPY).
- You dey make predictions: One currency go become stronger or weaker against di oda one?
- You dey buy or sell: If you think say di Euro go rise against di Dollar, you “buy” di EUR/USD pair. If e rise, you sell am at higher price and make profit. If e fall, you fit make loss. You fit also do di reverse: sell first and buy back at lower price.
Why you go trade forex?
So, wetin make forex trading popular like dis? See some reasons:
- 24/5 trading: Forex dey open 24 hours a day, five days a week. You fit trade any time wey fit your schedule.
- Easy to enter and exit: Na very liquid market, meaning say buyers and sellers dey always available. Dis dey make am easier to enter and exit trades.
- Diversification: Forex fit complement your trading portfolio alongside Stocks or oda asset classes.
Quiz
Wetin be one important characteristic of forex trading?


