Dtrader trading platform
For dis lesson, we go explore how you fit execute trades effectively wit di Deriv Trader platform. If you understand how to navigate di platform, you go fit make full use of di trading tools and resources wey dey available to you.
Introduction to Deriv Trader
Dem design Deriv Trader specifically to make trading across di different proprietary products wey Deriv offer easier. Di platform dey suitable for traders at every experience level, wit an interface wey beginners fit use easily and advanced tools for experienced traders.
Main features of Deriv Trader
- Trading environment wey you fit customise: You fit adjust di platform to suit how you prefer to trade, so e go be flexible tool for executing your strategies.
- Advanced charting tools: Use different charting timeframes, from tick-by-tick to daily candlesticks, to see price movements clearly. Di platform also get plenty indicators and drawing tools wey fit give you useful insights and allow you add your own notes.
- Plenty assets dey available: Deriv Trader give you access to pass 50 assets, including forex, Stock indices and Commodities during regular Market hours. Cryptocurrencies and Deriv synthetic indices also dey available for trading at any time, day or night.
- Trade types and durations: Di platform support different trade types wey suit different levels of risk wey traders dey willing to take and different trading styles. You fit choose and customise trade durations from just 1 second to as long as 365 days, so you fit use both short-term and long-term trading strategies.
How to start wit Deriv Trader
To start using Deriv Trader:
- Log in to di Deriv Trader Hub: Afta you log in, select “Deriv Trader” to access di platform.
- Open chart: To open chart for a particular asset, click di asset wey you wan trade from di Market Watch window.
- Add indicators: Click di “Add indicator” icon for di toolbar to add technical indicators. Choose from di different indicators to help you wit your technical analysis.
How to manage your trades
Deriv Trader clearly show di potential Payout before you execute trades, to help you assess your risk effectively:
- Trade amount and Payout: You fit choose your potential trading profit or loss as either Trade amount, by putting a specific amount for di trade, or Payout, by specifying di potential profit and allowing di platform to show di required Trade amount.
- Risk management features: For trade types like Multipliers, Deriv Trader provide additional tools like “Take Profit” and “Stop Loss” options to help you manage trades effectively.
How to navigate di platform
E easy to navigate di Deriv Trader platform. Di menu bar for di top give you easy access to important sections:
- Reports: E show your open positions, profit table and account statements.
- Cashier: E make deposits, withdrawals and fund transfers possible.
- Account settings: Manage your profile, password and security status.
- Account information: E show all your real and demo accounts together wit dia Balance.
For di footer menu, you fit find general information and settings, such as:
- Date and GMT: Use dem to keep track of Market hours.
- Live chat: Get customer support immediately.
- Help Centre: Access frequently asked questions and tips for responsible trading.
Conclusion
To conclude, di Deriv Trader platform offer powerful trading features wey you fit customise to meet your specific trading needs. If you learn how to use di platform well, you go dey well prepared to execute trades confidently and effectively.
We recommend make you start wit a free demo account to practise and improve your trading strategies using di tools wey dey available on Deriv Trader. For our next lesson, we go explore chart templates and profiles to help you improve your trading workspace further. Thank you for joining dis lesson, and we wish you happy trading!
Quiz
Wetin be di main function of di Deriv Trader platform?
Wetin be di main feature wey Deriv Trader dey offer make you fit customise your trading environment?
How Deriv Trader dey help you manage risk?


