
You don ever feel say di Market dey tok in riddles? Well, good news dey. E dey do so, but those riddles na actually chart patterns candlestick patterns!
Di best part? You no need to be maths expert or trading guru to spot dem. Your eyes naturally dey find patterns, so make we use dat skill! But before we go into patterns, make we tok about di tins wey form dem: support and resistance trend lines.
Trend lines: Di foundation of chart patterns
Trend line na simply line wey connect important price points for chart, like di opening prices ova one week or month. You fit see am as guide wey dey help traders spot possible price movements. Anytime di price cross dis line, dem dey call am breakout, wey be signal say new trend fit dey form.

Support and resistance na di most popular trend lines wey traders dey use.
Support and resistance: Di barriers for Market wey you no fit see
Support and resistance levels dey work like fences wey you no fit see, wey prices dey struggle to break through.

- Support: Di price level wia downtrend dey pause or bounce back up. Imagine say traders dey rush to buy asset wen e cheap, and dis dey stop di price from falling further.
- Resistance: Di price level wia uptrend dey slow down or reverse. Na wia traders dey start to sell, wey dey prevent di price from climbing higher.
Make we use example show how dis dey work:
Imagine say gold prices don dey fall for days. At $50 per gram, buyers rush in and push prices back up. Dat $50 level become support level.
Now, make we say gold climb reach $100 per gram. Some traders wey miss di dip decide say na time to sell. Supply pass demand, and prices stop to rise. Dat $100 level na resistance level now.
Prices often dey bounce between dis levels and form trends. But wen dem break through support or resistance, strong new trend fit soon form—na here opportunities dey open up for traders!
Drawing tools: Your digital sketchpad for trading
To spot trends, you go need to draw support and resistance lines on your price charts. Na here drawing tools dey useful! Most trading platforms, including Deriv Trader, dey offer different tools wey fit help you draw trend lines.

Helpful tip: If you just dey start, di Line tool fit help you well. Na di simplest way to draw trend lines and start to identify patterns.
Dis na example of support and resistance trend lines wey dem create wit di Line tool on ETH/USD candlestick chart for Deriv Trader:

How to turn trend lines into trading strategies trading strategies
Just knowing support and resistance levels fit already give you advantage, but if you combine dem wit chart patterns, your predictions fit become even more accurate! If you spot pattern early, e fit help you anticipate possible price movements and act accordingly.
Why not test your skills? Open Deriv demo account and start to practise how to draw trend lines and identify patterns in real time, without risking real money.
Enjoy your trading!
Quiz
Wetin be di main function of support and resistance levels for trading chart?


