Wetin be di commission calculation for MT5 Financial STP?
For every new client wey you refer wey complete their first trade on Deriv between 15 April and 30 May 2026, you go earn extra $3 on top your regular commission. No minimum threshold dey — every first-time trade count.
Commission = (Traded volume for USD) × (Commission rate) ÷ 100,000
To calculate traded volume for USD:
Traded volume for USD = (Volume for lots) × (Contract size) × (Execution price) × (Conversion rate to USD)
Example calculation wit AUD/CAD
Make we talk say:
- You trade 1 lot of AUD/CAD
- Each contract = 100,000 units (standard forex contract size)
- Di current price na 0.9000 (1 AUD = 0.9 CAD)
- Conversion rate (CAD → USD) = 0.73. Since di quote currency (CAD) no be USD, we go convert am to USD value.
- Di commission rate (one side) na $10 for every 100,000 USD wey person trade
How to calculate am:
1. Find di traded volume for USD:
1 (lot) × 100,000 (contract size) × 0.9000 (price) × 0.73 (CAD→USD) = 65,700 USD
So, di total traded volume = 65,700 USD
2. Apply di commission formula:
Commission= (65,700 × 10) ÷ 100,000 = 6.57 USD
So, $6.57 commission for each side
3. If you open and close di trade (round trade):
6.57×2 = 13.14
$12 total commission