Deriv innovative trading solutions receive MEA 2025 award

Deriv innovative trading solutions receive MEA 2025 award
Dem don recognise Deriv as di "Most Innovative Broker—MEA 2025" for di Dubai iFXEXPO, wey happen from 14 reach 16 January 2025. Dis award dey highlight di company dedication to innovation, trust, and excellent service.

Di beginning of AI integration through low-code development
Wit ova 25 years for di industry, Deriv don establish itself as leader as e dey offer cutting-edge platforms and solutions wey make trading accessible to pipo around di world. Di company adoption of low-code platforms don make workflows smooth and make development timelines move faster, so dem fit quickly update and improve tins.
To Embrace AI for Smarter Future
Deriv dey go through transformation journey to become AI-first organisation. Co-CEO Rakshit Choudhary tok say: “For 2025, our focus go be to put AI inside di DNA of every department and empower our teams to build dia capabilities.” Di future of AI for finance
AI go play central role for Deriv future strategy, as e dey optimise core operations like compliance, recruitment, and overall operational efficiency. Deriv dey take proactive approach to innovation as dem dey explore how to use AI tools take make di development and deployment of new trading products, so di company go remain for di front of di online trading industry and continue to exceed client expectations.
Prakash Bhudia, Head of Product and Growth for Deriv, emphasise di importance of di award: “To be named 'Most Innovative Broker - MEA' na testament to our relentless pursuit of excellence. Dis award dey show our mission to empower traders wit intuitive, cutting-edge solutions, while we dey ensure seamless and trustworthy trading experience.”
Di recognition wey Deriv receive for di iFXEXPO serve as milestone for im journey to redefine di trading landscape through technological advancements and strong dedication to im clients. Im commitment to innovation, together wit im client-centred approach, dey further strengthen im position as leader for di online trading industry. Di company get global presence for 20 locations, and dey serve diverse community of traders across different regions.