Dem don name Deriv 'Broker of the Year - Global' for di Finance Magnates awards

- Dem recognise Deriv for im efforts for Africa wit di Most Trusted Broker- Africa award.
- Few days afta e celebrate im 25th anniversary, dem don recognise Deriv for im commitment to excellent service and continuous innovation.
Dem don name Deriv “Broker of the Year—Global” and “Most Trusted Broker—Africa” for di Finance Magnates awards 2024. Di awards recognise Deriv 25-year mission to give excellent service to im clients around di world.
For di past 25 years, Deriv don establish itself as pioneer for di trading industry, as e dey consistently push boundaries while e still get strong foundation of reliability. As e dey use innovative trading technologies as im driver, Deriv don remain true to im mission to make trading accessible to everybody everywhere by offering different asset classes to clients worldwide.
Wetin make Deriv different na im ability to offer service wey dem tailor and localise, even though e get big global presence. Deriv get 22 offices worldwide, wey make am fit maintain 24-hour live chat help for different languages, to show Deriv commitment to customer satisfaction and trust.
Rakshit Choudhary, Co-CEO at Deriv, tok about how important dis achievements be, say, “As we receive di 'Broker of the Year - Global' award, e show say Deriv dey among di leading forces for di trading industry, wey pipo know for im different asset classes, cutting-edge platforms, seamless user experience, and outstanding customer support.”
Godfrey Zvenyika, Global Partnerships Manager and Country Manager of Africa at Deriv, tok say, “As we dey create our path as industry leader, African markets still dey important for our growth. Di Most Trusted Broker—Africa award no only recognise our current efforts, e still dey inspire us to continue to put resources for di region.”
New era dey ahead for award-winning broker
As Deriv dey look ahead, e still dey focus on im mission to empower traders globally, dey drive growth for emerging markets like Africa while e dey continue to deliver industry-leading technology and customer support. Wit dis recent accolades, di company dey well-positioned to continue im legacy of excellence for di next 25 years and beyond.